Full Conversation Using Question?

"Lets have full blown
conversations with just
QUESTIONS, it is a fun game to
ease out stress.
I.e,
LINUS: My guy, How far?
UCHE: Wetin dey happen?
LINUS: Why you jus dey call me now?
UCHE: You buy me credit?
LINUS: Dis one wey you call so, you wan show?
UCHE: Where u dey?
LINUS: You sabi Plus place?
UCHE: Make we block there?
LINUS: Before nko? Abi u wan make we block for anoda place?
UCHE: You get pay?
LINUS: Wetin you wan take money do?
UCHE: We no go drink?
LINUS: Na me born you?
UCHE: No be u be my chairman?
LINUS: E be like say craze don log on to u? Na my pay u go dey use maintain?
UCHE: Before nko?
LINUS: U serious abi you dey play?
UCHE: Bros, wetin u tink?
LINUS: So, u no really hold change eh? And u wan drink? U no dey shame?
UCHE: Bros, which ones na ? Na change for beer come dey cause dis kind yarn?
LINUS: Before nko?

@You: Now, this game promise
to be fun, aah abi? alright?

Comments